Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Joshua 2:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 Wen wi attack dis land, make yu tie dis red rope for di window wey yu for allow us kom down, den go pak all yor family enter yor house and evribody where dey stay yor papa house.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Joshua 2:18
19 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

So di men go bring Rahab, en papa, mama, brodas and evribody wey dey en house. Dem bring all en family kom out kon take dem go one place wey dey outside Israel pipol kamp.


Rahab kon sey, “I gri with evritin wey una tok.” E tell dem where dem go pass kon tie di red rope for di window.


Wen Moses read all di kommand give Israel pipol, e take goat and ram blood with wota and soap, kon sprinkol di blood on-top di Law Book and all di pipol body, den e sey,


So, I kon send pipol go koll yu and yu do well as yu kom. Na wi bi dis for God present, wi ready to hear wetin E sey make yu tell us.”


di priest go orda sey make dem bring two klean bird, part for cedar wood, red rope and some hyssop leaf.


Make God show en mesi to Onesiforus family, bikos e dey always make mi happy and e nor dey shame sey I dey prison.


Wen e kom, e go give yu di message wey God go use take save yu and yor family.’


As Pita still dey follow am dey tok wen e enter di house, e kon si sey many pipol gada dey wait am.


Den Jesus sey, “Salvashon don kom dis house today, bikos dis man na Abraham pikin too.


Den di priest go take cedar wood, hyssop leaf and one red rope kon put dem for fire.


Dem must use red klot and fine leda take kover am, den put di poles wey dem go take karry am for inside.


“Den I go turn yu to one strong kountry kon bless yu. Yor name go dey great and yu go get betta blessing.


So Oga God tell Noah, “Make una enter di boat, yu and yor family, bikos I si sey yu nor get fault among evribody for dis yor generashon.


Bikos how I wont take stay, if dis tin happen and dem kon kill all my pipol?”


Yor lips bi like red klot; yor mout sweet well-well. Yor fore head for di lite klot wey yu take kover, bi like pomegranate fruit.


Di blood go bi sign sey na una dey dat house, so dat wen I si di blood, I go waka pass and I nor go tosh una wen I dey ponish Egypt pipol.


But Joshua nor kill Rahab wey bi ashawo, en family and evritin wey bilong to am. Rahab kon stay for Israel, bikos e hide di pipol wey Joshua send go spy Jeriko.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka