Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Joshua 18:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Israel pipol gada for Shiloh and dem kon build di tent where dem for dey meet, for der. Aldo dem don win di land,

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Joshua 18:1
26 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Eleazar di priest, Joshua wey bi Nun pikin and Israel leaders, na dis bi di whole land wey dem divide and dem rite am for book kon put am for Shiloh for God present. So, dem kon divide di land finish.


Evry year, Elkanah dey from en town go woship and sakrifice to God for Shiloh. Na der, Eli two pikin (Hofni and Finehas) dey for serve God as priest.


for Shiloh wey dey Kanaan land kon sey, “God tell Moses sey make e give us town wey wi go stay and fields for awa animals.”


If una nor gri obey mi, den I go distroy dis temple, just as I distroy Shiloh. I go make sure sey evribody for dis eart dey curse dis town.’ ”


So Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe kon leave Israel pipol for Shiloh wey dey Kanaan, den dem go dia own house for Gilead wey God give dem thru Moses.


E skata en enemies kon disgrace dem forever.


So Jeroboam tell en wife, “Shange yorsef make pipol nor know who yu bi kon go Shiloh go meet Profet Ahijah wey sey I go bi king for Israel.


Den Solomon sey make Abiatar nor bi God priest again. So, wetin God tok for Shiloh about Eli and en shidren-shidren kon happen.


So di woman stay with en pikin until e kon big. Wen Hannah don train am rish, e kon karry am with three melu, one bag of flower and one kontaina of wine, go God house for Shiloh.


So Mikah juju dey der, as long as God Tabanako dey for Shiloh.


So di woman go Profet Ahijah house for Shiloh. Profet Ahijah nor dey si again, bikos e don old well-well.


Den, dem tink of di sakrifice wey dem dey do for God and na evry year for Shiloh, wey dey sout for Lebonah and nort for Bethel, dem for dey do am. E still dey east for di road wey dey between Bethel and Shekem.


“Afta, awa grand-grand papa dem karry di Tabanako wey God give dem with Joshua kon drive all di oda tribes and take dia land till di time wey David bigin rule Israel.


dem neva still give seven tribe for Israel dia own share for di land.


Wen di men kom out, Joshua kon tell doz wey dey go look di land sey, “Make una go waka round di land kon put am for map, den una go kom back kom meet mi, so dat I go trow dice for una for God present as wi dey Shiloh.”


Wen Israel pipol hear wetin happen, dem kon gada for one place for Shiloh to go fight dem.


From di time wey I save Israel pipol from Egypt till naw, I neva stay for temple; na only tent I dey stay and I dey waka from one place to anoda.


Dem win Kanaan land; Yu ova-take di pipol wey dey stay der. Yu give yor pipol pawa to do anytin wey dem like with Kanaan pipol and kings.


Den E leave en place for Shiloh, di Tabanako where E bin dey stay with en pipol.


Wetin make yu dey tok all dis foolish tins with God name? Wetin make yu dey tok with en name sey, ‘Dem go distroy dis temple, just as dem distroy Shiloh and nobody go dey here again.’ ” Den all di pipol kon gada round mi.


eight men kom from Shekem, Shiloh and Samaria. Dem don skrape dia hair, tear dia klot kon kut demsef to show sey dem dey mourn and dem karry korn and incense go offa for di temple.


and wi take di land as awa own, den una fit kom back, bikos una don do di work wey una suppose do for God and for Israel pipol. Den God go give una di land wey dey east for Jordan River.


But if una land nor dey okay bikos of sin, una fit cross kom meet us for di land where God dey. But make una nor build altar for unasef wey nor bi awa Oga God altar, bikos dat go show sey una dey fight against God and wi.


For all di pipol wey dey Jabesh, dem si 400 yong virgin wey neva sleep with man before kon bring dem kom di kamp for Shiloh wey dey Kanaan land.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka