Di borda na from sout go Kanah Valley. Dem give Efraim pipol some town among Manasseh towns, but Manasseh borda na nort for di valley and e end for di sea.
Near Issakar and Asher aria, dem give Manasseh, Bet-Shean, Ibleam where Dor town dey; Endor where Taanak dey and all di big and small towns wey dey near der.