Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Joshua 16:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Efraim pipol nor fit win all Kanaan pipol wey dey stay Geza. So Kanaan pipol still dey stay with Efraim pipol till today and dem bi Efraim pipol savant.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Joshua 16:10
12 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Efraim tribe nor fit drive Kanaan pipol wey dey Geza, so Kanaan pipol still dey stay der with dem.


Na Egypt king attack and kapture Geza before. E kill all Geza pipol kon burn di town. But wen en pikin won marry Solomon, e kon gi-am to di girl as marriage gift.


So Israel pipol pawa kon strong well-well pass Kanaan pipol own for dat aria, so dem kon force Kanaan pipol to bi dia slave, but dem nor fit win dem finish.


Doz wey kom from Ammon, Het, Periz, Hiv and Jebus dey too and dia shidren still bi slaves for Israel till today.


Judah men nor fit win all Jebus pipol wey dey stay Jerusalem, so Jebus pipol still dey stay with Judah pipol till today.


Den, Horam wey bi king for Geza kon kom help Lakish, but Joshua kill en and all en sojas finish.


Di big and small towns wey dem keep for Efraim family inside Manasseh aria dey join.


But di men for Manasseh nor fit win dis towns and Kanaan pipol still dey di aria with dem.


Solomon force some pipol build di temple, di palis and e fill di land for di east side kon build di town wall. E still use dem take ribuild Hazor, Megiddo and Geza town.


Dia shidren-shidren still dey di land (Israel pipol nor fit porshu all of dem komot from di land). So, Solomon kon use dem take dey do en work and na savant dem bi till today.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka