Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Joshua 15:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Kaleb wey bi Jefunneh son from Judah tribe, dem gi-am Kiriat-Arba (wey bi Hebron), just as God tell Joshua. (Na Arba bi Anak papa.)

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Joshua 15:13
18 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Den Kaleb tell di pipol sey make dem shut up kon sey, “Wi go attack naw kon take di land; wi dey strong and wi go fit konker di land.”


E die for Kiriat-Arba (wey bi Hebron naw) for Kanaan land. Abraham mourn and kry for Sarah.


from Judah tribe, e send Kaleb wey Jefunneh born;


Dem give dem Kiriat-Arba (na Arba bi Anak papa), wey bi Hebron for di hill kountry for Judah, plus di aria wey dey near am.


Dem mash against Kanaan pipol for Hebron (wey dem dey koll Kiriat-Arba before), dem stay der kon fight and win Sheshai, Ahiman and Talmai pipol.


Di man name na Nabal and en wife na Abigail. Di woman get sense and e fine well-well, but di man bad and na wiked tins e dey do. Na Kaleb tribe e from kom.


Wi go distroy Keret wey dey Negev for Judah aria and Negev aria wey bi Kaleb own. Wi burn Ziklag.”


Di lands and village wey dey di town, dem gi-am to Kaleb wey bi Jefunneh pikin.


So Abram karry en tent kon go stay near Mamre oak wey dey Hebron and e build anoda altar for God for der.


For dat time, Joshua attack and kill Anak pipol for di hill kountry, Hebron, Debir and Anab from all di hill kountry for Judah and Israel.


So dem selet Kedesh for Galilee wey dey Naftali kountry on-top di hill; Shekem wey dey Efraim kountry on-top di hill and Kiriat-Arba (wey bi Hebron) wey dey Judah kountry for hill.


So dem give Kaleb, Hebron town just as Moses promise. So Kaleb porshu Anak generashon komot der.


Hebron and doz wey dey di oda arias wey David and en men don travel pass before.


Afta dis, David ask God, “Make I go stay one town for Judah?” God ansa am, “Yes! Yu fit go.” David ask again, “Na wish one?” God ansa, “Na Hebron.”


Zorah, Aijalon and Hebron. Na dis towns dem guide well-well for Judah and Benjamin.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka