Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Joshua 14:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Naw, di land wey dey east for Jordan River, Moses divide am give two and di half tribe, but e nor divide any land give Levi pipol.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Joshua 14:3
9 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

But Moses nor divide land give Levi pipol as e bi sey dia propaty na di sakrifice ofrin, wey dem dey offa give di Oga wey bi Israel God, just as E tell dem.


Di oda half of Manasseh tribe, Reuben tribe and Gad tribe don kollect dia land wey dey di oda side for Jordan River, just as God savant Moses divide am.


“Wen dem don divide di land kon give all di tribes for Israel dia share, dem go dedikate one part give God. E go almost long rish nine mile kon wide pass three mile. All dis aria go dey holy.


God savant, Moses and Israel pipol win dis kings and Moses divide di land give Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe.


Dia aria start from Aroer (wey dey near Arnon Valley) plus di town wey dey di valley centre, evriwhere for Medeba,


Heshbon and all di towns wey dey near am; plus Dibon, Bamot Baal, Bet-Baal-Meon,


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka