Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Joshua 13:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 But Moses nor divide land give Levi pipol as e bi sey dia propaty na di sakrifice ofrin, wey dem dey offa give di Oga wey bi Israel God, just as E tell dem.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Joshua 13:14
12 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

As long as una dey dis land, make una dey kareful as una dey kare for Levi shidren.


For der, una must celebrate for di Oga una God present, with all una shidren, savants and Levi shidren wey dey stay una town, (bikos dem nor get land or propaty among una).


Dat na why Levi pipol nor get propaty or land among di oda tribes for Israel. Na God ensef bi dia propaty, just as di Oga una God tok.


But Israel pipol nor distroy Geshur and Maakat; So Geshur and Maaka pipol dey stay with dem till today.


Moses divide land give Reuben tribe akordin to dia family.


Moses nor divide land as propaty for Levi tribe; dia propaty na di Oga wey bi Israel God, just as E tell dem.


Di korn ofrin, di sin ofrin and all di oda ofrins; dem go bi di priests own and evritin for Israel wey di pipol give mi, go bi di priests own too.


But Levi pipol nor go get any land among una, bikos dia propaty na to serve God. Gad, Reuben and half for Manasseh tribe don already take dia part for Jordan River east wey Moses give dem.”


“Na mi bi di priests propaty for life and una nor go give dem any propaty; I bilong to dem and evritin wey dem wont, na mi.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka