“So naw, make yu si, God don keep mi rish naw, just as E promise. For dis forty-five years, even since God tell Moses en word wen Israel pipol still dey di wildaness kom rish naw, I nor die and naw, I bi eighty-five years.
Na di Oga una God bi di Pesin wey go cross before una. E go distroy all di oda kountries for una and una go porshu dem komot. Oga God sey na Joshua go lead una cross Jordan River.