Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Joshua 12:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Di kings wey Israel pipol win and take dia land for Jordan River east and from Arnon Valley go Mount Hermon, plus Arabah east na:

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Joshua 12:1
24 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Israel pipol pass thru di desert and dem nor tosh Edom or Moab pipol with dia land. Dem travel go east for Moab land kon go kamp for di oda side for Arnon River, but dem nor cross Arnon, bikos Arnon divide Moab kountry.


until God don give una brodas where dem go stay like una and until una win di land wey di Oga una God don sey E go give dem. Den una fit go back to una place wey Moses, God savant don give una for Jordan River east.”


But Israel pipol kill dia enemy well-well kon take di land from Arnon River for nort go rish Jabbok and Ammon side, but Ammon sojas bin guide dia aria well-well.


Den dem travel from der go di oda side for Amor for di wildaness wey wide from Amor, bikos Arnon na Moab borda wey dey between Moab and Amor.


Moab wimen dey wait for Arnon River front; dem dey waka up-and-down like birds wey dem drive komot from en house.


E bi like di dew for Hermon wey dey flow from Zion hill. True-true, na der God for sey en blessings go always dey forever and ever.


Naw, di Oga una God don guide una brodas and sistas, just as E promise dem. So make una go back to una house wey Moses, God savant divide give una for Jordan River east.


from Mount Halak to Seir go rish Baal-Gad for Lebanon Valley under Mount Hermon. Joshua katch all dia kings kon kill dem.


Kanaan pipol from di east and west; Amor, Hit, Periz and Jebus pipol from di kountry for hill and Hiv pipol from under Hermon for di aria wey dey Mizpa.


So Israel pipol take all di aria wey dey for Aroer near Arnon Gorge go rish Mount Sion, wey dem still dey koll Mount Hermon.


“So make una cross go River Arnon. Si! I don already give una Sihon wey bi Amor king for Heshbon and all en land. So make una go fight and take di land from am!


Wi nor go take any propaty for di oda side for Jordan River or for front, bikos wi don get awa share for dis east side for Jordan River.”


So Moses give Gad, Reuben and half for Josef first-born Manasseh tribe, all di aria wey bi Amor king, Sihon own and e still give dem king Og for Bashan own, plus di towns and kountries wey dey round dem.


Di oda half of Manasseh tribe, Reuben tribe and Gad tribe don kollect dia land wey dey di oda side for Jordan River, just as God savant Moses divide am.


Na Yu kreate di nort and sout. Mount Tabor and Mount Hermon dey praiz yor name.


Den E kon give dia land to en pipol, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.


Den, Israel pipol send messenja go meet King Sihon wey dey rule Amor sey,


Just as E kommand, wi go cross go Kanaan land go fight, so dat wi go get awa propaty for Jordan River east.”


Wen King Sihon and all en sojas gada kon fight us for Jahaz,


Den wi turn kon dey go Bashan and King Og for Bashan kon gada en sojas kom fight us for Edrei.


Dis na di law wey Moses give Israel pipol.


and as dem dey kamp for di valley near Bet-Peor wey dey east for Jordan River. (Amor pipol wey dia king bi Sihon wey bin rule form Heshbon, na dem get dis place before. But Moses and Israel pipol kom from Egypt kon distroy di king and en pipol.


Gibeah wey Uri born, naim dey kare for Gilead wey King Sihon from Amor and King Og for Bashan bin dey rule. Apart from dis twelf, e still get one govnor wey dey rule di whole land.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka