Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Joshua 11:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 God tell Joshua, “Make yu nor fear dem, bikos by dis time tumoro, I go distroy dem for Israel pipol front. Yu must cripple all dia horse kon burn dia shariot.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Joshua 11:6
24 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

God tell Joshua, “Make una nor fear, bikos I dey give dem to una. Non of dem go fit stop una.”


David seize 1,000 seven hundred horse-men and 20,000 sojas wey dey waka for groun. E keep like one hundred horse kon cripple di rest.


Dem kon tell di pesin wey dem send kom, “Dis na wetin yu go tell Jabesh: ‘Tumoro, una go dey save wen di sun don dey shine well-well.’ ” Wen di messenja go tell Gilead pipol di message, belle sweet dem well-well.


and na Finehas, wey bi Eleazar pikin and Aaron grand-pikin, bi di priest wey dey kare for am). Den Israel pipol ask God again, “Make wi go fight against awa rilative for Benjamin tribe or not?” God ansa. “Make una go! Tumoro, I go give dem to una.”


Joshua do dem, just as God kommand; e cripple dia horse leg kon burn dia shariot.


Assyria pipol nor go fit save us and awa shariot nor go fit protet us. Wi nor go ever tell juju again sey, ‘Na yu bi awa god!’ Na Yu God dey save doz wey nor get papa and mama again.”


Pipol wey dey go Egypt for help, curse dey dia head! Dem dey put dia hope for di plenty sojas, ordinary horse and shariot wey Egypt get. But dem nor trust Israel God or kom meet am make E help dem!


Instead, una sey, ‘No! Wi go enter awa horse kon run,’ and true-true, una go run. Una sey, ‘Wi go run with di horse wey fast pass,’ but doz wey dey porshu una, go fast pass una.


Good pipol dey always do di rite tin and God dey bless dia shidren.


God wey dey lead heaven sojas dey with us and na Israel God dey protet us.


E stop all di war for di eart kon break di bow and skata di spear, den E burn di shield with fire.


Make una go fight dem tumoro as dem dey kom Ziz. Una go si dem for one small river for Jeruel Desert front.


Joshua tell di pipol, “Make una go klean unasef, bikos for dis time tumoro, God go do strong mirakle among una.”


All di kountries wey di Oga una God dey give una, una must distroy all of dem finish. Make una nor sorry for dem at-all and make una nor woship dia gods, if not dem go trap una.


All dis kings gada for Merom River side, bikos dem won fight Israel pipol.


So Joshua and all en sojas attack dem for Merom River side wen dem nor know sey dem dey kom.


Dat nite, God tell Gideon, “Get up make yu go attack Midian pipol, bikos I don give yu viktory.


Di pipol wey dey stay Israel town go-go kollect doz tins wey dem take dey kill pipol kon use am do firewood and dem bi: di swod, di shield, di bow, di arrow, di spear and dem go use dem as firewood for seven years.


But Oga God wey dey lead Heaven Sojas sey, “Nineveh pipol, I bi una enemy! I go burn una shariot kon kill una yong men for war. Evritin wey una take from oda nashons, I go take dem from una hand and nobody go hear una messenjas vois again.”


Elisha ansa, “Make yu nor fear, bikos di ones wey dey with us, many pass di ones wey dey with dem.”


God sey, “Make una stand for where una dey, den una go know sey na mi bi God! Evry nashon go honor mi and evribody for di world go praiz my name.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka