42 Joshua katch all dis kings and dia land for just one fight, bikos di Oga wey bi Israel God dey fight for en pipol.
Dat kind tin neva happen before and e nor happen again. God listin to one man, bikos E fight for en pipol, Israel!
God wey dey lead heaven sojas dey with us and na Israel God dey protet us.
My God, make Yu bring us back to yorsef again. Make yor face shine upon us again and na only den wi go get rest of mind.
I go give out many nashons, so dat una go dey save. I value una well-well and I love and honor una.
God dey my side, so I nor go fear. So wetin ordinary pesin fit do mi?
Na God bi di strong place wey wi dey hide put and na-im dey help us wen wi dey trobol.
Bikos di Oga una God dey go with una! E go fight una enemies for una kon make una win di war!”
E make dia shariot taya sink and dem nor fit ride fast, den Egypt sojas kon sey, “Make wi run go back from dis pipol, na God dey fight us bikos of dem.”
God go fight for una, so make una nor worry.”
Den Joshua and all en sojas kon go back to dia kamp for Gilgal.