Joshua win di whole land plus di kountries for hill; di Negev; all di land for Goshen; di lowlands; di Arabah; di hill kountries for Israel and en lowlands,
Den wen E send una from Kadesh Barnea kon sey, “Make una go take di land wey I don give una,” una still sin against di Oga una God, bikos una nor bilive or obey am.
Ashkelon pipol go si all dis tins and fear go katch dem. Wen Gaza pipol go si dis tins, dem go bigin shake. Even Ekron pipol nor go get hope again. Dem go kill Gaza king kon distroy and skata Ashkelon town.
Dis na di towns wey Filistia pipol leaders for bring di gold sore wey dem offa to God, so dat E go forgive dem dia sin: Ashdod, Gaza, Ashkelon, Gat and Ekron.
Di day wey God put Amor pipol for Israel pipol hand, dat day Joshua pray to God for Israel pipol front sey: “Yu sun, make yu stay for where yu dey on-top Gibeon! And make di moon nor near dis side, just stay for where yu dey for Aijalon Valley!”
Dem kom back kom meet Moses, Aaron and Israel pipol for Paran Wildaness wey dey Kadesh kon tell dem evritin wey dem si and show dem di fruit wey dem bring from di land.
Den just as God kommand us, wi komot from Mount Horeb kon travel pass di great wildaness wey dey make pesin fear, just as unasef go remember, den wi face Amor pipol kountries. Wen wi rish Kadesh Barnea,