Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Joshua 10:24 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

24 Wen dem bring di kings kom meet Joshua, e koll Israel men kon tell di sojas oga wey dey with am sey, “Make una kom here kon mash dis kings for dia neck.” So dem kom put dia legs for di kings neck.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Joshua 10:24
18 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

And God wey dey give peace, go soon distroy Satan for una. Make awa Oga God Jesus Christ grace dey with una.


Den for di day wen I go do all dis tins, una go mash wiked pipol for groun and dem go bi like ashes under una leg.” Dis na wetin Oga God tok.


Di Oga God stand for yor rite hand to protet Yu and E go kill many kings, wons E don dey vex.


Di OGA tell my Oga God, “Make Yu sidan for where honor dey for my rite hand, until I don put all yor enemies under yor leg.”


God nor sorry for dia prince, instead E make dem dey waka for di dry and empty land.


Israel pipol, si as una dey happy! Who bi like una? Una bi pipol wey God diliver, bikos na God dey protet una and na-im bi una swod. Make una enemies kry before una and una go mash dia back pass.”


Una go mash lions and kobra pass; una go mash wiked lions and snakes go dey under una leg!


Yu put my leg for dia neck and I don distroy evribody wey hate mi.


Den e tell en senior pikin Jeta, “I kommand yu make yu kill dem!” But di pikin nor gri bring out en swod, e dey fear, bikos e still bi small boy.


Na wish angel God tell, “Sidan for my rite hand until I go put all yor enemies under yor leg?”


Yu dey make my enemies run from mi and I distroy doz wey hate mi.


But I go gi-am to pipol wey dey opress una; doz wey dey make una liedan for street kon waka on-top una like sey una bi dirty.”


I nak dem fall and dem nor fit stand again, bikos I defeat dem.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka