1 As Jonah dey inside di fish belle, e kon pray to God.
Wen dem koll mi, I go ansa dem; I go dey with dem wen dem dey trobol. I go save and make pipol honor dem.
Even if E kill mi, I go still dey bilive am; I go still tell am wetin dey do mi!
God, wen wi dey pass thru pain, wi kry, pray and look for Yu, bikos of di way Yu dey ponish us.
Afta, make una koll mi wen una dey trobol and I go kom save una, den una go give mi all di glory.”
If anybody dey sofa among una, make e pray. If anybody dey happy among una, make e sing dey praiz God.
I go leave my pipol until dem don sofa well-well for dia sin, den dem go dey look for mi. Yes! Dem go really look for mi bikos dem dey sofa.”
Di valley go bring out wota wey yu go drink and I don kommand birds make dem bring food kom give yu for der.”