Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jonah 1:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Jonah ansa, “Make una trow mi inside di wota and di breeze go stop. Bikos na mi kause dis wahala for una.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jonah 1:12
10 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

David si di angel wey dey kill di pipol and e tell God, “Na mi dey guilty, na mi bi di pesin wey do wrong. Wetin dis poor pipol do? Make yu ponish mi and my family.”


So David pray, “My Oga God, na mi do wrong; na mi sey make dem kount pipol. Wetin all dis poor pipol do? Abeg, make Yu leave dis pipol kon ponish mi and my family.”


Israel pipol nor fit stand for dia enemies front; dem run bikos disgrace don dey follow dem. I nor go dey with una again, unless una distroy wetin make dis wahala dey happen to una.


kon sey, ‘Make yu nor fear Paul! Yu must face Caesar and God go save yu and evribody wey dey follow yu travel.’


Una nor know sey e betta make one man die for evribody, dan sey make evribody for dis kountry die?”


So wisdom dey good pass swod, but one sin fit distroy many-many good tins.


Bikos di breeze dey strong more-more, dem kon ask am, “Wetin wi go do yu naw make dis breeze for stop?”


Instead, dem kon try to padol di ship go land back, but dem know fit, bikos di breeze strong well-well.


Just as yor wikedness dey affect only pipol wey dey do like yu, na so too di good wey yu do, go affect doz wey dey do good.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka