7 Wen dem kontinue to dey worry am, e kon get up tell dem, “Any of una wey neva kommit sin before, make e bi di first pesin to stone dis woman.”
Make all of una word dey good and sweet like wetin dem put sugar, so dat una go know how to ansa evribody.
So, make yu turn from sin kom meet God! If not, I go kwik-kwik kom fight yu with di swod wey dey my mout.
One sharp swod dey kom out from en mout and e go take am distroy all di kountries. E go rule dem with strong hand and E go mash di grapes wey dey bring wine with strong vexnashon, bikos na God get all di pawa.
E whole seven stars for en rite hand and swod wey get two sharp side, dey kom out from en mout. En face dey shine like sun.
Di sojas ansa, “Wi neva si anybody wey tok like dis man before!”
My message bi like fire and na hammer wey dey break rock into pieces.
Foolish pipol dey tok anyhow, but wetin wise pipol tok, dey heal many wound.
E kon bend down again bigin rite for groun.
Den Jesus stand up ask am, “Madam, where di pipol wey bring yu? Nobody remain to kondemn yu?”