Di man ansa, “Who sey make yu kom judge us? Yu dey plan to kill mi as yu take kill dat Egypt man?” Den Moses kon dey fear, so e tink kon sey, “True-true, pipol don know wetin I do.”
Dem kon shaut gi-am sey, “Komot for awa front, yu wey bi strenja for dis place; na yu won tell us wetin wi go do! Wetin wi go do yu go worse pass wetin wi go do dem.”