Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




John 7:51 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

51 “Awa law nor dey kondemn pesin unless wi don hear wetin di pesin tok or si wetin e dey do, abi nor bi so?”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




John 7:51
8 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Make yu dey listin well before yu ansa, If not, e go bi like sey yu bi stupid pesin wey nor get respet.


Make una nor favor anybody and na as una take listin to rish man kase, na so too una go take listin to poor man own. Make una nor fear anybody, bikos na God dey judge evribody. Any kase wey una nor fit judge, make una bring am kom meet mi.’ ”


So Paul tell am, “God go slap yu too, yu wey dey pritend! Yu sidan dey judge mi with di law, yu nor dey disobey di law wen yu sey make dem slap mi?”


But make una nor ever kill pesin, bikos of wetin one pesin tok. Two or three pesin must tok di same tin, before una go fit stone pesin die.


“Make una nor dey tok wetin una eye nor si. Make una nor join wiked pipol lie for pesin head.


“ ‘Anybody wey dem akuiz sey e kill pesin go dey guilty, dem go fit kill-am, if two or more pipol bear witness sey na true. But if na only one pesin tok against am, den dat one nor rish to kill-am.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka