Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




John 6:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Plenty pipol follow am, bikos dem si wen e heal pipol wey nor well.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




John 6:2
19 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Wen Jesus hear sey dem dey plan to kill-am, e kon komot from der. Many pipol follow am and e kon heal all of dem wey nor well.


Dis na di first mirakle wey Jesus do and e happen for Kana wey dey Galilee. Dis na how e show en honor, so en disciples kon bilive am.


But many pipol si dem wen dem dey go, so di pipol kon run with leg from all di towns kon first Jesus and en disciples rish di place.


As e kom down from di boat, e si plenty pipol, so e sorry for dem kon heal all di pipol wey nor well among dem.


Afta Jesus kom down from di mountin, plenty pipol kon follow am.


Many pipol gada round am, so e enter one boat and all di pipol sidan for groun near di wota.


But as di man dey go, e kon bigin shaut for evriwhere dey spread di story, sotey Jesus nor fit enter any town again, so e kon dey stay where pipol nor dey. But pipol still dey kom meet am from evriwhere.


Jesus dey for Jerusalem by di time wey dem dey do di Passova Feast. For der, many pipol kon bilive am, bikos dem si di mirakles wey e do.


E hide go meet Jesus for nite kon tell am, “Tisha, wi know sey yu bi di pesin wey God send kom meet us, bikos nobody fit do di mirakles wey yu dey do, unless God dey with am.”


So wen di pipol si di mirakle wey Jesus do, dem kon dey tok among demsef sey, “True-true, dis man na di profet wey God send kom dis world.”


Wen day don break, di pipol wey dey di oda side for di river know sey na only one small kenu dey der. Dem still know sey Jesus enter di kenu with dem.


Jesus ansa dem, “Make I tell una true word, na bikos of di bread wey una chop naim make una dey find mi, nor bi bikos of di mirakles wey una si.


Dem still ask Jesus, “Wish kind mirakle yu go do make wi si, make wi for bilive yu?


Den di priest oga dem and Farisee pipol kon koll di kansol memba dem togeda, ask dem, “Wetin wi go do, since dis man dey do plenty mirakles?


And dem gada go meet Jesus, bikos dem hear sey na-im wake Lazarus from grave.


Aldo Jesus don do many mirakle for dia front, dem nor still bilive am.


Jesus do many mirakles wen e dey with en disciples wey dem nor rite for dis book.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka