6 Wetin flesh born, na flesh e bi, but wetin God Spirit born, na spirit e bi.
So, if any man dey inside Christ, e don dey new, Christ don klean di bad tins wey e do before and evritin don turn to new one!
Pesin wey bi God pikin, nor dey like to sin, bikos God seed dey inside am.
So anybody wey join Christ, don get one spirit with am.
I know sey wetin dey inside mi nor go let mi do good. Even wen I won do good, I nor dey fit.
God look di eart kon si sey e dey bad well-well, bikos all di pipol dey live wiked life.
My God, make Yu put betta heart inside mi and make yor spirit strong inside mi too.
Anybody fit dey klean before God? How yu wey woman born won take dey pure?
No klean tin fit kom from wetin nor klean like human being.
Bikos if una dey follow sin, una go die. But di Spirit pawa go kill all di bad tins wey una dey do, so dat una go get life.
All of us dey live dis kind life before. Wi dey do difren tins wey awa body and mind wont. Dat time, wi bi shidren wey God won ponish like oda sinnas.
Dem sekonsaiz una inside am. Dis nor bi human being sekonsishon, but na di spirit own wey Christ dey do.
Pipol wey dey inside Christ don kill dia flesh with all di bad tins wey di flesh dey like to do.
Dem go bi God shidren, nor bi as dia papa and mama take born dem from belle, or bikos somebody make dem so, but bikos God ensef make dem en own shidren.
Wen wi still dey di world, di law dey make us do bad tins wey awa body wont and all dis tins dey bring deat.
But di Oga God si as human being wikedness don strong for di eart. Evritin wey dem dey tink for dia mind, na how to do evil tins.
Wen Adam don old rish hundred and thirty years, e kon get one pikin wey bi like am and en name na Seth.
Tank God! Jesus Christ don save mi. So, I go obey God law with my mind, even doh sin pawa still dey inside mi.
So, make yu nor konfuse bikos I tok sey, ‘God go born yu for di sekond time.’