Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




John 2:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Jesus ansa am, “Mama, why yu dey tell mi? My time neva rish.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




John 2:4
20 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Jesus ansa dem, “Time neva rish for mi to go, but una fit go anytime una like.


Before dem do di Passova Feast, Jesus know sey en time don rish wen e go komot for dis world go meet en Papa. Bikos e love di pipol wey dey di world, e kon show dem how en love for dem strong rish.


Jesus dey tok to dem near di box where dem dey put ofrin money, wey dey inside di temple. Nobody fit katch am, bikos en time neva rish.


Dem kon try to katch Jesus, but nobody fit tosh am, bikos en time neva rish.


Jesus tell dem, “Di time don kom wen God go honor en own pikin.


Evritin wey dey happen for dis world, dey happen for di rite time wey God wont make e happen.


Di demons kon hala, “God Pikin, make yu leave us o-o, abi yu kom sofa us wen time neva rish?”


But David tell Abishai and Joab en broda, “Who make una judge? Yu won give mi trobol? Na mi bi Israel pipol king naw and nobody go kill Israel pesin today,”


But di king tell Abishai and Joab en broda, “E nor koncern una. If e curse mi, bikos God tell am make e curse mi, who get di pawa to ask am why e dey curse mi?”


Jesus tell am, “Woman, why yu dey kry? Na who yu dey find?” Bikos Mary tink sey naim bi di gardina, e kon sey, “Oga God, if na yu karry am komot, make yu tell mi where yu karry am go, so dat I go-go karry am.”


Dem kon ask am, “Woman, why yu dey kry?” Mary ansa, “Dem don karry my oga komot and I nor know where dem karry am go.”


Jesus ansa dem, “Why una dey find mi? Una nor know sey I go dey my Papa house?”


So Jesus tell am, “Madam, yor faith big well-well! Make wetin yu dey find rish yor hand.” Dat same time, di pikin kon well.


Dem tell dia papa and mama sey, ‘Wi neva si am’ and e nor do like sey e know us or en own shidren, bikos dem keep yor word kon guide yor kovenant.


So naw, wi nor dey look anybody like ordinary human being. Even doh wi bin know Christ like dat before, wi nor know am like dat again.


Di woman go meet Profet Elijah kon sey, “God savant, why yu do mi dis kind tin? Yu kom here kon make God remember my sins, den kill my pikin?”


Wen wine finish, Jesus mama kon tell am, “Dia wine don finish.”


Make una go di feast, I nor go-go, bikos my time neva rish.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka