Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




John 13:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 E pour wota for basin, bigin dey wosh en disciples leg and dey dry dem with di towel wey dey en waist.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




John 13:5
30 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Den Jesus look di woman kon ask Simon, “Yu dey si dis woman? I enter yor house, yu nor give mi wota wosh leg, but di woman don wosh my leg with en tears kon take en hair klean am.


Make Yu wosh and klean mi from di bad tins wey I do. Klean mi from all my sins.


E kon sey, “Una my oga! Abeg, make una kom enter una savant house. Make una wosh una legs and na here una go sleep dis nite. Den tumoro morning, una fit kontinue una journey.” Di angels kon sey, “No! Wi go sleep for di town centre.”


Evribody go know am for di good work wey e dey do sey: e don train shidren; dey welkom strenjas; dey serve God pipol; dey help doz wey nor get and e dey do difren good work.


Make I bring some wota kom make una take wosh leg; una fit rest for under di tree.


I kon ansa, “My oga, na yu know di ansa.” Den e sey, “Dis pipol die bikos of Christ. Dem don use di Lamb blood take wosh dia klot, naim make am white like dat!


So make wi draw near God with betta heart and strong faith, bikos God don wosh awa heart and body with klean wota.


so dat e go fit make am klean, thru baptizim and God word.


Na so some among una bi before, but naw, God don wosh una klean thru Jesus Christ name and en Spirit pawa, don make una klean for en eye.


Naw, wetin yu dey wait for? Get up, make dem baptize yu, so dat God go forgive yu yor sin, as yu koll en name.’


But King Jehoshafat ask, “Wi nor get any profet among us for here? Make e help us find out from God.” One of Israel king savant kon ansa, “Shafat pikin, Elisha wey bin dey pour wota for Elijah hand, dey here.”


Abigail stand up, bow face groun kon sey, “Yor woman savant wey dey alone, go wosh my oga savants leg.”


“Di pesin go wosh e klot, barber en hair kon baf; den e go dey klean. E go fit enter di kamp, but e go stay outside en house for seven days.


Na Jesus Christ kom dis world with wota and blood. Nor bi only with wota, but na with di wota and di blood. And God Spirit bear witness sey dis na true, bikos na God Spirit bi di trut.


But if wi dey inside di lite as en ensef dey inside lite, all of us go bi en friend and Jesus wey bi en pikin, go use en blood take wosh all awa sins komot.


But one soja kon take spear shuk di korna of en belle, den blood and wota kon dey rush kom out.


E knee down for Jesus front dey kry and e kon dey wet Jesus leg with di tears from en eye. E klean Jesus leg with en hair kon kiss dem, den e pour di oil put.


God sey, “For dat day, I go open one place where wota go for rush kom wosh David shidren-shidren and Jerusalem pipol from all dia sins and all di bad-bad tins wey dem dey do.


I go pour klean and good wota for una body, so dat una go dey klean from di juju wey una dey woship before and evritin wey make una dirty.


and from Jesus Christ, di witness wey dey tok trut; di first-born among doz wey God raiz from deat and naim bi di King of all kings. Christ wey love and free us from awa sins with en own blood;


Make una go wosh unasef klean and stop all di evil tins wey una dey do.


“Yu go bring Aaron and en sons near di door-mot for di tent where dem for dey do meetin kon wosh dem with wota.


Jesus ansa, “Di pesin wey don baf, only nid to wosh en leg, bikos e don dey klean. Una dey klean, but nor bi all of una.”


Pita tell am, “I nor go gri make yu wosh my leg!” Den Jesus ansa, “If I nor wosh yor leg, mi and yu nor go get anytin togeda again.”


Di man kon take dem enter Josef house. E give dem wota and dem kon wosh dia legs. Den e give dia donkey food chop.


So e take dem go en house kon feed dia donkey. Afta dem don wosh dia leg, dem kon chop and drink togeda.


Wen e rish Simon Pita turn, Pita kon tell am, “Oga God, yu won wosh my leg?”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka