Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




John 1:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Na God make evritin and if to sey E nor make dem, dem nor for dey dis world at-all.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




John 1:3
20 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

But wi (wey bi Christian), na only one God wi get and naim bi awa Papa. Na-im kreate evritin and wi dey live for am. Na Jesus Christ bi awa only Oga God. Na-im make evritin and na thru am wi get life.


“Awa Oga and God! Yu dey worthy to receive glory, honor and pawa, bikos na yu kreate evritin as yu wont.”


Na with di word wey God tok, E take kreate di heavens. E breath en word and all di stars for heaven, appear.


Den God sey, “Make wi kreate human being like Awasef, just as wi bi, so dat dem go bi oga ova di fish dem for sea and di birds for di sky, plus di kattles and ova di whole eart plus evritin wey dey inside.”


E kom inside di world wey e make my ensef, but di pipol nor know am.


God wey kreate di heavens and di eart sey, na-im still bi God! Na mi kreate di eart well and I nor kreate am to dey empty, but na for pipol to stay. E sey, “Na mi bi God and e nor get anoda one.


Na mi bi di Pesin wey kreate di eart and na mi kreate di pipol wey dey stay inside. Na my pawa I take stresh di heavens out kon kontrol di sun, moon and di stars.


Na wen di world just start, Yu build di foundashon for di eart kon make di heavens with yor hand.


Di grace na to make evribody undastand God sekret plan. Na God kreate evritin and E hide di plan since e kreate di world.


Wen di world just start, na God kreate di heaven and di eart.


I dey near am like pesin wey dey design house before dem build am. Na mi dey make am happy evriday and I dey happy for en present.


Di Word dey with God from wen time bigin.


Na thru faith wi take undastand sey, God kreate evritin with en word. So di tins wey wi dey si so, na God make dem from wetin dem nor dey si.


Anybody wey bilive sey na Jesus bi Christ, don bi God pikin and anybody wey love di Papa, love di pikin wey E born.


“Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Laodicea: ‘Dis message na from di Pesin wey bi di Amen; di witness wey dey obey God kommandment since E kreate di world.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka