Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Joel 1:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Una wey dey drink anyhow, make una wake-up bigin kry. Una wey dey drink wine, make una kry; bikos dem don distroy di grape and all una sweet wine don finish.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Joel 1:5
13 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Yu wey get money, make yu listin! Cry make dem hear yor vois, bikos of di bad tins wey go happen to yu.


“E get one rish man wey dey wear dear-dear klot and e dey enjoy life evriday.


Dem trow dice take divide who go take my pipol as slave. Dem sell boys and girls as slave kon use di money take buy wine and karry ashawo.


Una wey bi priests wey dey serve for di altar, make una wear sak klot kon kry! Make una go mourn for di temple till day break, bikos korn and wine nor dey wey una go offa give una God!


Una wey bi farmer and doz wey dey kare for di vineyards, make una kry, bikos of una rice and sweet korn. Yes! All wetin wi plant don skata.


“Man pikin, go tell Egypt pipol wetin mi God wey get pawa dey tok. “Make yu shaut tok dis word sey: ‘Wahala day dey kom!’


So make una wear sak klot, kry and roll for groun, bikos God still dey vex well-well for Judah.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka