Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 9:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Just as dem dey do one wiked tin finish, na so dem dey start anoda one. Dis pipol nor gri listin to mi wey bi God.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 9:6
21 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Dis wiked pipol nor gri obey mi. Dem dey follow dia sturbon and wiked heart kon dey woship and serve oda gods. So dem go bi like dis nika wey nor get value again.


Since dem nor gri put God for mind and serve am, E kon leave dem make dem use dia bad mind dey do tins wey dem nor suppose do.


My pipol don die finish bikos dem nor know mi. Since di priests don rijet mi, misef go rijet dem as my priests. Since una don forget una Oga God laws, misef go forget to bless una shidren.


I hear as pipol dey gossip mi. Dem dey koll mi, “Di Man Wey Fear One Kill.” Dem dey treaten sey, “If yu tok anytin here, wi go ripot yu.” Even my friends before, dey look and dey wait make I fall. Dem dey sey, “E go fall enter di trap, den wi go know sey wi don revensh am back.”


Before dis time, I bi like lamb wey dem won go kill, even doh I nor know anytin. I nor know sey na mi dem dey plan dis kind wiked tin for. Dem bin sey, “Make wi kut di tree naw wey e still dey fresh; make wi kill-am, so dat nobody go remember am again.”


Den, wen dis pipol turn from mi, why dem nor turn back kom meet mi? Instead, dem whole dia juju tight and nor gri turn kom meet mi.


Just as hunta pak bird full kage, na so dem pak money wey dem get thru wayo full dia house and na dis make dem rish well-well kon get pawa.


Una nor ever get wetin to do with wisdom and una nor gri obey God.


I dey koll and invite una since, but una nor gri listin or hear mi.


Make una get sense and stop to dey kommit sin. I still dey sopraiz sey some pipol among una nor know God.


Den di pipol sey, “Make una kom, make wi do sometin about dis Jeremaya! Wi go always get priest wey go dey to tell us wetin wi go do; wise pipol go dey wey go advise us and wi go always get profet wey go prish God word give us. So make wi lie against am kon stop to listin to anytin wey e tok.”


Eli sons dey wiked and dem nor dey do wetin God kommand.


Melu know en owner, donkey sef know who dey gi-am food, but Israel wey bi my pipol nor know or undastand mi at-all.”


Dem don kontinue di wiked tins wey dia grand-grand papa dem do before, wey make dem nor obey my kommand. Demsef don dey woship oda gods. Both Israel and Judah pipol don break di kovenant wey I make with dia grand-grand papa.


I go take akshon against una. I go make una dey pure like iron wey dem burn, den una go dey klean.


God go use en pawa take judge and make di nashons holy. E go forgive Jerusalem pipol dia sins kon klean di land bikos of pipol wey dem kill for der.


Efraim pipol, how I won take leave or abandon una? I nor fit distroy una just as I distroy Admah pipol or trit una as I trit Zeboiim pipol? My heart nor go let mi do am, bikos di love wey I get for una, too strong.


I go test di third part wey survive kon klean dem, just as dem dey klean silva for fire. I go test dem, just as dem dey test gold. Den dem go pray give mi and I go ansa dem. I go tell dem sey dem bi my pipol and dem go sey, ‘Na di Oga bi awa God.’ ”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka