Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 8:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 Medicine nor dey Gilead again? Doctors don finish for here? If dem dey, wetin make dem neva cure my pipol?

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 8:22
17 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Egypt pipol! Make una go Gilead go find medicine, but all una medicine nor go work and nor-tin go fit heal una.


Wen dem sidan make dem bigin chop, dem kon si some karavan wey karry Ishmael pipol dey kom from Gilead. Dia kamel karry spice, balm and myrrh dey go Egypt.


But na wons Babilon fall kon skata. Make una mourn for am! Make una find medicine for am, may bi dat one fit cure am.


One woman dey among dem wey don dey mestrate for twelf years naw, bikos nobody fit heal am.


Den dia papa Israel tell dem, “If na so e go bi, den make una do dis tin for mi: Make una karry some among di best tins wey wi get put for una bags kon give di man as gift; small balm, honey, spices and myrrh, pistachio and almond.


I wish sey my head bi like well wey wota full and my eyes bi like fountain where wota for dey rush kom out, den I go kry well-well both day and nite for my pipol wey dem kill.


Den I sey, “My God, Yu don forget Judah pipol? Na so Yu hate Zion town? Wetin make Yu dey do us like dis, sotey wi nor dey okay again? Wi dey hope for peace, but na wahala wi dey si. Wi dey bilive sey wi go well, instead na trobol dey follow us.


Wetin I go fit tok? Who don ever si dis kind sofa before? Wetin I go fit take kompare yu, Jerusalem? How I go fit take konfort yu? Bikos di wound wey yu wound, deep like sea. Na who go fit heal yu?


Naw Reuben and Gad pipol get many kattle. Wen dem si sey Jazer and Gilead land dey good


Just as well dey bring fresh wota kom out, na so too Jerusalem dey bring all en wikedness kom out. I dey hear war and distroshon nois for di town kon si wound and sickness for evriwhere.


God sey, “I go pak dirty full Jerusalem and jackals go dey stay der, den I go turn Judah town to desert where nobody dey stay.”


“Even doh Judah royal palis fine like Gilead land and Mount Lebanon, I go turn am to desert and pipol nor go stay der again.


Judah and Israel pipol dey buy goods from una with wheat, honey, olive oil and spices.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka