Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 8:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Even wen wi pray for peace, na wahala dey follow us. Wi bilive sey wi go rest small, but na trobol dey porshu us.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 8:15
9 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Den I sey, “My God, Yu don forget Judah pipol? Na so Yu hate Zion town? Wetin make Yu dey do us like dis, sotey wi nor dey okay again? Wi dey hope for peace, but na wahala wi dey si. Wi dey bilive sey wi go well, instead na trobol dey follow us.


Wen pipol dey sey, “Evritin dey okay and peaceful,” na dat time wahala wey go skata evriwhere go kom and e go bi like di pain wey woman dey face wen e won born and nobody go eskape from am.


True-true Marot pipol dey wait for who go save dem, but God don bring wahala kom Jerusalem.


Dem dey trit my pipol wound like sey na ordinary tin. Dem sey, ‘Evritin go dey okay!’ Even wen dem know sey nor bi so e go bi.


Den I sey, “God wey get pawa, wetin make Yu deceive Jerusalem pipol? Yu bin sey peace go dey, but naw, Yu dey ready to kill.


Na happiness and lite I dey hope for, but na trobol and darkness I kom get.


So my pipol, make una nor go farm or travel go anywhere, bikos di enemies dey der with dia swod and dem dey kause wahala for evriwhere.”


Pipol don tif all di tins wey dey di land. I send sojas go distroy di land and nobody for der go get peace.


Trobol dey kom. Una go look for peace, but una nor go si am.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka