Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 6:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 My Oga God, just as Yu dey vex for dem, na so too I dey vex and I nor fit hide my vexnashon again.” Den God sey, “Di shidren wey dey play for di street and di yong men wey gada togeda, make yu pour my vexnashon for dia body. Dem go seize and karry husband and wife go and dem nor go even sorry for old pipol.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 6:11
22 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

But wen I sey, “I go forget God and I nor go tok with en name again,” na dat time yor message dey bi like fire wey dey burn inside my body. Even wen I try to pritend sey nor-tin dey happen, I nor dey fit.


Bikos deat don klimb pass awa windows. E don enter awa house wey dem guide well. E don kill awa shidren wey dey play for di street and di yong men wey dey di town centre.”


But na God pawa and spirit dey my body. E give mi sense to judge well with strent to take tell Israel pipol about dia sin.


Den I hear one loud vois dey tok to di angels from di temple sey: “Di seven basins wey God vexnashon dey, make una go pour dem for di eart.”


Wen Silas and Timoti kom from Masidonia, Paul kon use all en mind dey prish di word, dey tok to Jew pipol sey, na Jesus bi di Christ.


As Paul dey Atens dey wait for dem, e kon dey vex for en spirit, bikos e si sey na so-so juju full di town.


bikos wi nor go fit sey make wi nor tok about wetin wi don si and hear.”


I tell una true word, dat nite, two pipol go dey one bed, God go take one kon leave di oda one.


Make una kill both old and yong pipol; weda na papa, mama or pikin. But make una nor tosh anybody wey get di mark for en head. Make una start from my temple.” So dem kon start with di leaders wey dey der.


So God pawa enter my body with force and as en spirit dey karry mi go. I kon dey vex, but God hand rest for my head with pawa.


But naw, make honga kill dia shidren and make dem die for war. Make di wimen luz dia husband and shidren; make diziz kill di men and make di yong men die for war.


So, di Oga God sey, “I go pour my vexnashon for dis land. I go pour am put for both pipol and animals body and even di trees and food wey dem plant. My vexnashon go burn like fire and nobody go fit kwensh am.”


Even yong pipol go taya and strong yong men go kwik too.


Una don rijet and turn from mi and na dis make mi vex kon bring wahala for una. I don taya to dey sorry for una.”


I nor dey spend my time to play and enjoy mysef with oda pipol. I dey always dey alone; dey obey yor word and I dey vex for evil pipol, bikos of wetin dem don do.


God don turn all my strong sojas to fool. As E kommand, many sojas kom distroy my sojas. God mash and press my pipol, just as dem dey press grape.


Si yong and old pipol don die for di street. Enemies don kill both boys and girls. Yu don kill dem, bikos Yu dey vex and Yu nor sorry for dem wen Yu dey kut dem.


E sey, “Man pikin, dis book wey I dey give yu so; make yu chop am till yu beleful.” I kon chop am and e sweet like honey.


I tell Israel pipol dis message: ‘Una dey happy, bikos of una temple. Una like to dey look and go der, but I go distroy am and di small-small pipol wey una get for Jerusalem go die for war.’


Naw, God sey, ‘I go really ponish dem for evritin wey dem do. Yes! I go bring sorrow and pain kom dis nashon!’ ”


I still sey, “Naw, wimen! Make una listin and hear wetin God dey tok. Make una tish una dotas and friends how to kry and sing beri song.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka