Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 52:33 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

33 So e allow Jehoiashin shange en prison klot, den Jehoiashin kon always dey chop from di king tabol until di day wen e die.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 52:33
9 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

David tell am, “Make yu nor fear. I go dey kind to yu, bikos of Jonatan wey bi yor papa. I go give yu evritin wey bi Saul, yor grand-papa own and anytime wey yu kom my tabol, I go welkom yu.”


“But make yu dey kind to Barzillai shidren wey kom from Gilead kon kare for dem, bikos dem dey kind to mi wen I dey run from Absalom, yor broda.


So Mefiboshet wey nor fit waka kon dey stay for Jerusalem and dey chop for di king tabol.


Den Fero take en own ring from en hand kon wear am for Josef own. E wear en fine klot for Josef kon put gold shain for en neck.


Den Fero sey make dem go koll Josef kom. So dem take Josef kwik-kwik komot from di prison kon shave en hair and shange en klot, den dem take am go meet Fero.


Den di angel tell doz wey stand near am, “Make una pul di dirty klot wey dis man wear so, komot from en body.” Den e tell Joshua, “I don forgive yu all yor sins and naw, I go give yu new klot make yu wear.”


Naw, Yu don turn my sorrow to happiness. Yu remove di klot wey I take dey mourn kon wear joy for my body like klot,


E give King Jehoiashin new klot and King Jehoiashin kon dey chop evriday for di king tabol,


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka