Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 51:62 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

62 Den make yu pray sey, ‘Oga God! Yu don sey Yu go distroy dis place and pipol or animals nor go stay der again and e go dey empty forever.’

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 51:62
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Afta I don vex ponish Babilon, nobody go stay der again. Dem go distroy am finish. Doz wey dey waka pass go si am kon sopraiz well-well, bikos of di wahala wey don happen to am.


Na from nort one nashon go kom attack and distroy Babilon. Babilon go turn desert where nobody dey stay, bikos en pipol and animals go run komot der.’ ”


I go make una dey empty forever and nobody go stay una town again. Den una go know sey na mi bi God.


Babilon go turn where dem dey trowey dirty put and trobol go dey follow am. Pipol go fear and hate dem and nobody go stay der again.


Di eart dey fear and shake, bikos God dey do wetin E plan wen E sey E go turn Babilon to desert where pipol nor dey stay.


“ ‘But wen di seventy years don finish, I go ponish Babilon and en king for dia sin. I go distroy and skata dat kountry forever.


‘I go koll di pipol wey dey nort and my savant King Nebukadnezzar for Babilon and dem go kom fight against Judah pipol and di towns wey dey round Jerusalem. I go distroy and skata dis nashon and di ones wey dey round am, forever. I go make pipol si and dey fear dem.


God wey mighty sey, “Dis land wey bi like desert where pipol or animals nor dey stay, I go turn am to where fresh green leaf go dey and shepad go take dia sheep go chop for der.


Di town don turn where pipol dey fear to stay and e bi like desert wey nor get wota; where pipol nor dey stay or travel pass.


Den I tell Seraya, “Wen yu rish Babilon, make sure sey yu read evritin wey I rite loud make evribody for hear yu.


But dem go disgrace una and shame go katch dis great town. Babilon go bi last among nashons wey dem dey fear; e go dry kon turn empty desert.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka