Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 51:58 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

58 Dem go distroy Babilon strong wall kon burn dia big-big gate. Evritin wey Babilon build, go skata go like dat.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 51:58
13 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

But make una dey sure about dis! Oga God wey dey kommand heaven sojas don tok: Evritin wey di nashons dey do nor mean anytin; all dia work go dey yuzles.


sey, ‘Dis na wetin go happen to Babilon. E go sink and e nor go raiz-up again, bikos of di way God go distroy am.’ ” Na here Jeremaya message for finish.


I go ponish Bel wey bi Babilon god and make am drop all di tins wey e tif and di nashons nor go woship am again. Naw, Babilon wall don fall.


Make una shaut for war for evriwhere for di town! Den, Babilon pipol go surenda. Dem go skata di town wall, bikos mi wey bi God, dey take revensh. So make una trit am, just as e trit odas.


Babilon sojas don stop to fight and dem dey for dia tent. Dem nor get hope again and dem don weak like woman. Dem don break di town gate for groun kon burn all di house with fire.


Strenjas for der sey, ‘Wi bin won kom help Babilon town, but e don too late. Make wi leave am kon go back to awa house, bikos God don ponish Babilon pipol kon distroy di town.’ ”


Unless God build house, di pipol wey dey build am, just dey waste dia time. Unless God guide town, doz wey dey guide am, nor go fit protet am.


Dem go susid for di work wey dem dey do and dia shidren nor go sofa. I go bless dem and dia shidren-shidren forever.


Make yu go on-top di hill go raiz di war flag! Make yu shaut and wave yor hand, so dat di sojas go fit enter di prince gate.


Even all di many advise wey dem advise yu don make yu weak well-well. Yor pipol wey dey read di star and doz wey dey tok as weda go bi, make dem kom out kon save yu from wetin go soon happen to yu.


Friends dey deceive friends and nobody dey tok trut. Dem don train demsef to dey lie and do bad tins. Dem nor gri turn from sin kom meet God.


Dem really dey porshu us and naw, wi don taya, but wi nor fit rest at-all.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka