Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 51:55 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

55 I go distroy Babilon and nobody go hear en vois again. Sojas go rush kom attack dem like wota for sea and dem go sey,

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 51:55
18 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

I nor go make una happy or do marriage again. Una nor go si oil pour for una lamp and korn nor go dey for una to chop.


Den di angel kon tell mi, “Di wota wey yu si, wey di ashawo sidan on-top, na many pipol, tribe, kountry and language.


“Difren-difren signs go show for sun, moon and star. For inside dis world, pipol for difren kountries go dey worry and fear, bikos of di way rivers go dey move and wota go dey rush from sea enter land.


Naw, dis na wetin mi God wey get pawa dey tok: Tyre town, I bi una enemy and I go bring many kountries kon fight una and dem go kom like wave for sea.


Di sea rush enter Babilon and naw e don kover di town.


“Babilon, sidan for darkness and make yu kwayet, bikos pipol nor go koll yu kween again!


Even doh dis pipol dey make nois like heavy wave for sea, wen God shaut for dem, dem go turn run go one far land and na breeze go karry dem like leaf for hill or like dirty wey strong breeze blow.


Dis message na about Moab. True-true na one day God go take distroy am; dem go distroy Ar and Kir wey dey Moab for one singol day.


Yu make di rof sea kwayet kon silent di nashons wey dey kause trobol.


Deat dey round mi and trobol won kill mi;


I dey sink enter mud; di place wey di groun soft well-well. I dey for deep wota and di wota dey karry mi go.


If to sey God nor really dey awa side wen pipol attack us,


River for don kover us; wota for don karry us go.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka