Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 51:39 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

39 As dem dey hongry, I go prepare food, so dat dem go chop and drink kon happy. Den dem go sleep kon die go like dat.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 51:39
12 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

I go make en ofisas, wise men, leaders and sojas drink anyhow. Dem go sleep and dem nor go wake-up again. Mi, wey bi God, don tok. I bi di Oga God wey dey mighty.


Den God tell mi, “Tell di pipol sey mi, Israel God wey dey mighty, dey kommand dem make dem drink till di drink katch dem. Dem go dey vomit until dem fall for groun and dem nor go fit get up again, bikos I dey send war kom meet dem.


Naw, Nineveh, yorsef go stagga fall like who don drink. Yu go run go hide from yor enemies, den yu go kom dey beg for help.


En enemies bi like dry shuku-shuku for bush. Yes! Dem bi like pesin wey don drink well-well. True-true, fire go burn dem like dry grass.


So for dat nite, dem kon kill Belshazzar wey bi Babilon king.


God sey, “Make Moab stagga kon fall like pesin wey don drink, bikos dem go against mi. Moab go roll on-top en vomit and pipol go laf am.


My Oga God, make Yu turn kon ansa mi! Make yu give mi strent again or I go die.


Assyria king! Yor leaders don die and yor ofisas don sleep go forever! Yor pipol skata on-top di mountin and nobody dey to bring dem kom house again.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka