10 God sey, “My pipol, make una shaut sey: ‘God don show sey wi dey do di rite tin. So make wi go tell doz wey dey Jerusalem wetin God do for us.’
(Make una listin! Pipol wey nor get house dey run komot from Babilon go Jerusalem kon tok as di Oga awa God ponish Babilon pipol, bikos of wetin dem do to en temple.)
E go show sey yu dey innocent kon defend yu for publik.
Doz wey Yu don save go rish Jerusalem with joy, dem go dey sing and shaut with happiness. Dem go dey happy and dey free from sorrow forever.
Give Jerusalem pipol heart. Tell dem sey dem don sofa rish and God don forgive dem dia sins. Yes! I don ponish dem well-well for dia sins.
Save mi so dat I go fit praiz Yu for publik for Jerusalem gate. Yes! I go dey happy bikos Yu don save mi.
Den evribody go dey fear and dem go tok about di mighty and wonderful tins wey God don do.
So make una listin to di plan wey I get against Babilon town and en pipol. Dem go drag dia shidren go like sheep kon skata dia house.
Kom! All of una wey dey loyal to God, make una listin as I dey tok wetin E do for mi!
So I nor go die, instead I go live to tok about all di wonderful tins wey God don do.
Di pipol wey go survive go sing with happiness; doz wey dey for west go tok how God big and great rish