45 So make una listin to di plan wey I get against Babilon town and en pipol. Dem go drag dia shidren go like sheep kon skata dia house.
So make yu listin to di plan wey I get for Edom pipol and wetin I won do to di pipol wey dey Teman town. Dem go drag dia shidren go and I go distroy di land finish bikos of di tins dem do.
All tins dey happen as God wont am and thru Christ, E choose us to bi en own pipol, bikos na so E plan am from di time wen E kreate di world,
and dem dey do wetin yu don already plan sey go happen.
Even if una kill Babilon sojas well-well and na only di men wey una wound remain, dem go still kom burn dis town rish groun.”