Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 50:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 God sey, “Wen dat time rish, Israel and Judah pipol go kry kom find mi wey bi dia God.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 50:4
32 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

But di time dey kom wen Israel pipol go turn kom meet Oga God and one among David shidren-shidren, go bi dia king. Den dem go fear God and E go bless dem.


Den Judah and Israel pipol go kom togeda as one again. Dem go choose one pesin wey go lead dem and dem go plenty kon prosper for dia land again. Yes! Dat day for Jezrel, go dey great well-well!


God sey, “Di time dey kom wen I go make new kovenant with Israel and Judah pipol.


“Den I go pour my spirit to pray and to show mesi for David shidren-shidren body and di oda pipol for Jerusalem. Dem go dey look mi, di pesin wey dem shuk, den dem go mourn like pesin wey dey mourn en only pikin. Dem go kry well-well like sey na dia first boy pikin die.


Dis na wetin make God sey, “Make una turn from sin kom meet mi naw wey time still dey. Make una give mi una heart. Make una fast, kry and mourn as una dey kom meet mi.


God wey get pawa sey, “But naw, I go sorry for Jakob shidren wey bi Israel pipol kon make dem prosper again. Yes! I go guide my holy name.


For dat time, I go choose king wey dey raitious from David shidren-shidren. “Di king go do wetin dey korrect and good for evriwhere for di land.


I just feel sey di time to save my pipol don rish and na di rite time to ponish dia enemies bi dis.


Make una turn and pray to God naw wen E dey near una.


I nor dey tok for sekret or for di dark place for di eart. I neva ever sey, ‘Jakob shidren just dey follow mi for nor-tin.’ Mi wey bi God dey tok di trut. Yes! I dey tok wetin dey rite.”


Oga God go pity en pipol, Israel. E go choose dem as en own kon let dem stay di land again and strenjas go kon stay der with dem.


Make wi look for God and en pawa wey E dey give! Make wi always dey look for am!


Make una kry and make sorrow dey una heart, den una go show sey una nor dey happy.


So Ishmael kry komot for Mizpa go meet dem. Wen e si dem, e kon sey, “Abeg! Make una kom si wetin happen to Gedalaya!”


Yu go remember how yu bihave, den shame go katch yu wen yor senior and yonga sista go kom back kon meet yu. I go let dem bi like yor pikin.


Make una kom make wi turn go meet God! Na-im wound us, but E go heal us! Even doh E wound us, E go bandage awa sore.


if my pipol go honbol demsef kon pray to mi and turn from dia sins, I go hear and ansa dem from heaven kon forgive dia sins, den heal dia land.


I go shaut like lion kon fight my pipol enemies, den my pipol go follow mi. Dem go rush kom meet mi from west.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka