Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 50:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Dem go tif and karry evritin wey dey Babilon. Mi, wey bi God, don tok.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 50:10
12 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

“ ‘But wen di seventy years don finish, I go ponish Babilon and en king for dia sin. I go distroy and skata dat kountry forever.


Di ten horns wey yu si and di beast, go hate di ashawo kon kollect all wetin e get, den e go dey naked. Dem go chop en body kon burn am with fire.


All di nashons go serve en and en shidren-shidren, until wen en own nashon go fall. Den Babilon go bi savant to nashons wey get pawa and great kings.


I go give yu betta tins wey dem hide for dark and sekret place. Den yu go know sey, na mi bi God! Israel pipol God, wey koll yor name.


For dis time, all awa enemies ship rope don slak; di ship don weak well-well! Wi go seize all di propaty wey awa enemies sojas get kon divide dia propaty among doz wey nor fit waka.


Awa enemies propaty dey skata like plant wey ant chop.


Make una from far kom attack Babilon! Skata where dem keep dia food put! Gada am like dirty kon distroy am finish! Make una kill evribody wey dey der!


But naw, una go si as I go take pay Babilon pipol for all di bad-bad tins wey dem do to Jerusalem.


Zion pipol sey, ‘Just as Babilon pipol sofa us, na so too God go sofa dem and make God pay dem back, bikos dem kill awa pipol.’ ”


Leta, God Spirit karry mi go meet di odas for Babilon. Den di vishon kon finish


Dem go distroy en horse and shariot. Sojas wey dem hire from oda land, go dey fear and dem go weak like woman. All dia betta-betta tins go skata and pipol go tif and karry di ones wey remain.


Una don tif from many nashons, so doz wey still dey alive, go tif from una. Una don kill pipol kon kause wahala for di whole world.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka