Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 50:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 God tok thru Profet Jeremaya about Babilon and en pipol. E tell am sey,

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 50:1
22 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

bikos know profesy don ever kom out from human being mind. Instead, na di Holy Spirit dey kontrol di pipol wey dey tok God word.


So Abraham leave Kaldean kountry kon go stay for Haran. Afta en papa die, God kon tell am make e stay for dis land wey una dey naw.


All di nashons go serve en and en shidren-shidren, until wen en own nashon go fall. Den Babilon go bi savant to nashons wey get pawa and great kings.


Make una si Kaldean town, pipol wey nor know where dem from kom! Assyria pipol don turn di land to where wild animals dey stay. Dem don skata dia towas, distroy dia strong town kon turn am to where dem dey trow dirty put.


dem go laf Babilon king kon sey, “Make una si as evritin take end for di king wey dey opress pipol! E nor go ever fit opress anybody again!


As dis one still dey tok, anoda savant run kom sey, “Oga! Kaldea pipol form three group kom attack us. Dem karry all di kamel kon kill yor savant dem and na only mi one eskape kom tell yu.”


“God Spirit dey tok thru mi; en message dey for my lip.


Terah kon karry en pikin Abram, en grand-pikin Lot and en pikin wife Sarai, dey follow body go Ur for Kaldea, so dat dem go-go Kanaan. Wen dem rish Haran, dem kon stay for der.


For di first time, en kingdom na Babel wey bi Babilon, Erek, Akkad and Kalneh wey dey Shinar land.


Anoda angel follow di first one kon sey: “E don fall! Babilon don fall! Babilon wey make all di kountries drink di wine wey make dem dey sleep with who dem nor marry.”


Dat na why dem koll di town, Babel, bikos God give dem difren language and from der, E skata dem for evriwhere for di world.


Instead of Israel pipol, Assyria king kon pak strenjas from Babilon, Kutah, Avva, Hamat and Sefarvaim go stay for Samaria towns.


“ ‘But wen di seventy years don finish, I go ponish Babilon and en king for dia sin. I go distroy and skata dat kountry forever.


For di third year wey King Jehoiakim dey rule for Judah, King Nebukadnezzar for Babilon kon attack Jerusalem.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka