Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 5:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 So Jeremaya, anytime wey yor pipol ask, “Wetin make di Oga God ponish us like dis? Make yu ansa, ‘Na bikos dem leave God go woship oda gods for dia land and bikos of dat, una must go serve as slave for anoda land.’ ”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 5:19
18 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

So, I go drive una komot from dis land go where una and una grand-grand papa nor know at-all; land where una go dey woship oda gods both for day time and for nite, bikos I nor go sorry for una.” ’ ”


And wen una ask, “Wetin make all dis tins dey happen to us? Why dem tear awa klot komot from awa body kon trit us like ashawo? Na bikos of sin?” Yes! Na bikos una don sin.


Doz wey bi awa slave before, don turn awa oga naw and nobody dey to save us from dia pawa.


una still sey, ‘Wi neva do any bad tin at-all, so God nor go vex for us again.’ But make una look! I go make sure sey I judge una, bikos una sey, ‘Una neva kommit any sin.’


bikos my pipol don kommit two difren sin against mi: dem don leave mi wey bi di spring wey dey give dem fresh wota and dem dig one well for diasef wey nor fit keep and gada wota.


“Israel pipol, dem nor born una as slave; na for war dem for katch and karry una go as slave.


But I nor go distroy una finish.” Dis na wetin God tok.


God sey, “Go tell Jakob shidren-shidren and all Judah pipol sey:


God ansa, “Dis tins happen, bikos my pipol rijet di law wey I give dem. Dem nor gri obey or do wetin I sey make dem do.


So I ask, “Na who wise rish to undastand wetin make dis tins happen? Na who God don tell wey fit esplain why e bi like dis? Wetin make di land skata kon dry like desert wey pipol nor fit travel pass?”


Una go komot for di land wey I give una and I go make una serve una enemies for di land wey una nor know, bikos my vexnashon bi like fire and e go burn forever.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka