Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 49:23 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

23 Dis na wetin God tok about Damaskus: “Di pipol for Hamat and Arpad town dey worry and dem nor get rest, bikos dem hear bad news. Dia mind dey trobol dem like river and dem nor fit rest.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 49:23
35 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

I don win Kalno, Karkemish, Hamat and Arpad towns. Yes, I still win Samaria and Damaskus pipol.


Where di gods wey dey Hamat and Arpad? Where di gods wey dey Sefarvaim, Hena and Ivvah? True-true, una tink sey any god fit save Samaria from my pawa?


But wiked pipol bi like sea wey dey make nois anyhow; en wave nor dey finish and na so-so dirty e dey bring.


So for nite, Abram divide en men against di four kings men kon win dem. E porshu dem go rish Hobah wey dey nort for Damaskus.


Na wons dem tif and empty evritin for di town kon turn am to where dem dey trow dirty put. Dia heart melt and dia leg kon dey shake. Honga won kill pipol and pipol face don dey shange kolour!


Where di kings for Hamat, Arpad, Lair, Sefarvaim, Hena and Ivvah?’ ”


So dem kon go shek di land from Zin and Rehob Wildaness, where dem dey pass enter Lebo-Hamat.


But Abram sey, “My Oga God wey get pawa, wetin Yu go give mi, since I neva born pikin and na dis Elieza for Damaskus go inherit my propaty?”


For Damaskus, King Aretas sey make di govnor put sojas for di town gate, so dat dem go arrest mi.


Wen wi nor si sun or star for many days and di breeze still dey worry us, wi kon luz hope sey wi don die bi dat.


kon take pamishon to go Damaskus, so dat if e si anybody wey dey follow Jesus Christ wey bi di Way, weda na man or woman, e go arrest dem kom Jerusalem.


Make una go si wetin happen to Kalneh land, den pass der go Hamat-Rabbah and Filistia pipol town for Gat. Una nor si as dem distroy dem, abi una betta pass dem?


Where di king dem wey dey for Hamat, Arpad, Sefarvaim, Hena and Ivvah town?”


So bikos of dis, evry hand go weak and evribody heart go fail am.


Wen dat day rish, Israel pipol wey dey Assyria, Patros, Sudan, Elam, Babilon, Hamat, di towns wey dey near di sea and Egypt, God go use en pawa take bring dem kom back to Jerusalem.


King Asa take all di silva and gold wey dey di temple and di royal palis kon send dem with message go give King Ben-Hadad for Siria, wey dey rule Damaskus sey:


Instead of Israel pipol, Assyria king kon pak strenjas from Babilon, Kutah, Avva, Hamat and Sefarvaim go stay for Samaria towns.


kon bi leader to some pipol wey nor dey respet di law. (Dis tin happen afta David don win King Hadadeza kon kill all di sojas for Siria.) Rezon and en men go stay for Damaskus where en men for make am Siria king.


Den all di men wey dey strong like lion go dey fear, bikos evribody for Israel know sey yor papa na great soja and en men dey fight well-well.


King Toi for Hamat hear sey David don defeat Hadadeza sojas.


Doz wey follow mi kon dey make Israel pipol fear, but I still dey loyal to di Oga my God.


Wen wi hear di news, fear katch us and wi kon dey tink sey wi go die wons wi si una. Bikos di Oga wey bi una God, na God for heaven, eart and evritin wey dey under di eart!


Den di soja oga go sey, “E get anybody among us wey dey fear or en heart dey shake? If na so, yu fit go house before yu go make anoda pesin, fear too.”


Den Edom leaders go fear well-well; di strong men for Moab go dey shake and di pawa wey Kanaan pipol get, go vanish.


Amanah and Farpar for Damaskus nor betta pass all di rivers for Israel? Why e nor send mi go one of dem, so dat I go well?” So Naaman vex komot from der.


bikos na Damaskus bi Siria main town and na King Rezin dey rule for der. But na like sixty-five years e go take to skata Israel, and dem go distroy all of dem finish.


Where Hamat and Arpad gods dey naw? Where Sefarvaim gods dey sef? E get anybody wey save Samaria?


But Babilon sojas porshu dem kon katch Zedekaya near Jeriko. Den dem take am go meet King Nebukadnezzar for Riblah town wey dey Hamat land and na for der Nebukadnezzar for judge am.


Damaskus pipol dey buy una goods kon pay with wine from Helbon


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka