Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 49:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Shidren wey nor get papa and mama, make yu leave dem for mi and I go kare for dem. Wimen wey nor get husband, make dem make dem kom meet mi and I go help dem.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 49:11
12 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Na en bi papa to di pipol wey nor get papa and na en bi husband to wimen wey dia husband don die. God dey rule from en holy place.


But betta relijon wey nor get stain for God eye, naim bi dis: to kare for shidren wey nor get papa and mama and wimen wey dey sofa bikos dia husband don die. So, make una keep unasef, so dat dis world nor go stain una.


Assyria pipol nor go fit save us and awa shariot nor go fit protet us. Wi nor go ever tell juju again sey, ‘Na yu bi awa god!’ Na Yu God dey save doz wey nor get papa and mama again.”


Naw, woman wey en husband don die and e really dey alone for dis world, dey trust God. E dey pray for nite and day sey make God help am.


Oga God sey, “I go judge pipol wey dey do majik; doz wey dey sleep with who dem nor marry; pipol wey dey tok wetin dia eye nor si; oga dem wey nor dey pay dia workers; doz wey dey opress wimen wey dia husband don die, shidren wey nor get papa and mama again and strenjas. Dem dey do like dis, bikos dem nor dey fear mi.


den why yu feel sey I know go sorry for Nineveh town wey dey for darkness? Place where en pipol many pass one hundred and 20,000 and wey get many animals.”


God dey guide di strenjas among us. E dey kare for pipol wey nor get papa and mama and wimen wey dia husband don die, but E dey ponish wiked pipol with dia wiked plans.


Poor pipol and doz wey nor get papa, make una judge dia kase well! Make una free poor pipol and doz wey dem dey opress.


Doz wey nor get papa and mama and doz wey nor get husband again, E dey make sure sey E fight for dem. E dey show love to strenjas wey dey stay with una kon give dem food and klot to wear.


Make una nor opress wimen wey dia husband don die; shidren wey nor get papa and mama; strenjas wey dey una town; doz wey nid una help and make una nor plan bad against each oda.’


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka