Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 48:45 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

45 Pipol wey nor get house kon find help go Heshbon, di town wey King Sihon dey rule before, but fire don burn di town. Fire don burn doz wey dey give Moab pipol hope.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 48:45
12 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

‘I don si am, but nor bi naw e go happen; Even doh I hold am, e nor dey near my hand. One star go kom out from Jakob pipol. E go kom out from Israel like septa. E go kill Moab pipol and Seth sons.


Bikos fire kom out from Heshbon, betta fire kom out from Sihon town. E don distroy Ar wey dey Moab and di ogas wey dey for Arnon.


Jesus kon tell dem, “Una neva read God word wey sey: “ ‘Di stone wey di builders rijet don bikom di pila? Dis na God work and e dey wonderful for awa eye.’


Rulers, leaders and kommanders go kom from Judah and some go rule my pipol.


So I go use fire take distroy Moab town kon burn Keriot strong-strong buildings rish groun. Moab pipol go die for war and dia sojas go dey shaut and trumpet dey blow.


Heshbon na King Sihon town for Amor. Naw, e don fight against di king wey dey Moab before kon take all en land from der go rish Arnon.


Den, Israel pipol send messenja go meet King Sihon wey dey rule Amor sey,


Moab pipol, curse dey una head. Kemosh pipol, una don skata! Una make una sons dey run anyhow and una dotas don turn King Sihon for Amor, prisonas.


Na fire kill dia yong men and dia yong wimen die even before dem sing dia wedding song.


Sihon wey bi Amor pipol king and King Og for Bashan and all di kingdom for Kanaan,


Yes! Memfis and Egypt sojas don distroy Israel glory and dem nor dey fear mi again.


Pipol nor go praiz Moab again. Enemies don seize Heshbon land kon plan as dem go take distroy Moab town. Dem go distroy Madmen town too and na wiked sojas go mash kom skata am.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka