Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 48:33 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

33 Di happiness and joy wey dey Moab land, don vanish. I don make dia wine stop to flow from di winepress. Nobody dey to make wine for dem and una nor go hear happiness nois from der again.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 48:33
13 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Dat time, una go where dem pak korn full, dey tink sey una go si twenty sak, but na only ten una si. Una go draw fifty gallon for wine, but na only twenty una get.


True-true, big vineyard go produce only five gallon of wine and ten basket of seed go produce only one basket of good korn.


Wi just dey look as dem dey distroy awa food and wi nor fit do anytin. Nobody dey happy for God temple again.


Una wey dey drink anyhow, make una wake-up bigin kry. Una wey dey drink wine, make una kry; bikos dem don distroy di grape and all una sweet wine don finish.


Yu don make di pipol plenty kon give dem great joy. Dem dey happy for yor present, just as doz wey dey harvest wetin dem plant dey happy or as sojas dey celebrate wen dem divide wetin dem karry kom from war.


Wen dat time rish, di vineyard wey fine well-well and get one tazon vine wey rish one tazon pieces for silva, shuku-shuku go grow kover am.


Na so-so kry pipol go dey kry for evry vineyards. All dis go happen, bikos I dey kom ponish una.” God wey get pawa don tok.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka