Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 48:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 Dem go ansa, ‘Moab don fall! Make una kry for am, bikos dem don disgrace am. Make una shaut near Arnon River sey, “Moab don skata!” ’

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 48:20
10 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Moab wimen dey wait for Arnon River front; dem dey waka up-and-down like birds wey dem drive komot from en house.


True-true, pipol dey hear as Moab pipol dey kry for evriwhere and dia kry dey rish Eglaim and Beer-Elim town.


Israel pipol pass thru di desert and dem nor tosh Edom or Moab pipol with dia land. Dem travel go east for Moab land kon go kamp for di oda side for Arnon River, but dem nor cross Arnon, bikos Arnon divide Moab kountry.


Dia own aria go start from Aroer (wey dey near Arnon Valley), plus di town wey dey di valley centre; evriwhere for Medeba go rish Dibon


From Aroer wey dey River Arnon korna (River town), go rish Gilead, e nor get any town wey fit fight us. Di Oga awa God give us all doz towns.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka