Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 48:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Pipol nor go praiz Moab again. Enemies don seize Heshbon land kon plan as dem go take distroy Moab town. Dem go distroy Madmen town too and na wiked sojas go mash kom skata am.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 48:2
20 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

God promise sey, “As long as di world dey, na so too, Israel go bi my nashon forever.”


But naw, God sey, “For di next three years, Moab pipol and dia propaty go vanish komot dis eart and na few pipol go survive among all di pipol and dem go dey weak well-well.”


Reuben pipol kon ribuild Heshbon, Elealeh, Kiriataim,


Heshbon pipol, make una kry, bikos dem don distroy Ai! Rabbah wimen, make una wear sak klot kon mourn. Make una dey konfuse, bikos dem go karry una god, Molek with en priests and princess, go anoda kountry.


Pipol wey nor get house kon find help go Heshbon, di town wey King Sihon dey rule before, but fire don burn di town. Fire don burn doz wey dey give Moab pipol hope.


Moab go skata and nobody go know am again, bikos God don curse am.


Una wey dey stay near dat nashon, make una mourn for am. Yes! All of una wey know en glory. Make una sey, ‘Si as en strong pawa don break; en glory and en pawa nor dey again.’


I go kom meet and save una. I go distroy all di nashons where I skata una go, but I nor go distroy una. I go must ponish una, but I go do am to korrect una. Mi, wey bi God, don tok.”


“Yu si as pipol dey sey I don rijet Israel and Judah pipol; di two family wey I choose? Na dis make dem nor dey respet my pipol at-all, bikos dem nor si dem as strong nashon again.


So I take di cup from God hand kon go di nashons wey God send mi go and I make all of dem drink from am.


Oga wey bi Israel God tell mi, “Make yu take dis wine cup wey my vexnashon full and make all di nashons wey I send yu go meet, drink from am.


God go protet and guide Mount Zion, just as pipol dey mash grass pass, na so too E go take distroy Moab pipol.


My heart dey kry for Moab pipol, bikos di pipol don run go Zoar, Eglat and Shelishiyah town. Some even dey kry as dem dey go Luhit, while odas eskape go Horonaim town.


Dis message na about Moab. True-true na one day God go take distroy am; dem go distroy Ar and Kir wey dey Moab for one singol day.


I go make Elam pipol fear dia enemies. Bikos I dey vex, I go distroy Elam pipol kon send sojas go porshu dem until I don kill all of dem finish.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka