Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 48:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 God sey, “Moab pipol dey always stay for peace and dem neva ever karry dem go do slave work. Moab pipol bi like wine wey dem leave make e setol rish groun; wine wey dem nor dey pour from cup to cup. Yes! Di wine still sweet and en taste still good as e bi before.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 48:11
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

I go use lantan take find all Jerusalem korna wey darkness pass, so dat I go ponish doz wey love to sin. Dem bilive sey God nor go fit do dem anytin; weda good or bad.


but I dey vex for di nashons wey feel sey dem dey save. Bikos as I dey try make I nor vex for my pipol, doz nashons dey make my pipol sofa more-more.


Judah and Israel pipol bi like tree wey en enemies break en branches, but Oga God go make dem grow again kon give dem glory and pawa.


Moab pipol too dey proud! I don hear as dem proud and sturbon rish and how dem dey tink of demsef alone.


Di world go skata finish and nor-tin go remain. God don tok and na so e go bi.


Judah pipol sey, “Wi don hear how Moab pipol dey karry body up. Wi know sey di pipol sturbon well-well, but na empty mout dem just dey make.”


Di wahala wey wi get, don taya us and awa trobol, plenty well-well.


God wey dey rule forever go hear mi kon deal with dem, bikos my enemies nor gri shange from di wiked tins wey dem dey do and dem nor dey fear God.


King Nebukadnezzar for Babilon don skata, chop and distroy my town like empty cup. E swallow am like wiked animal and na awa propaty full en belle. E still porshu us komot from awa own land.


For Mount Zion, God wey dey lead heaven sojas go do big party for all di pipol for di world. For di party, plenty food go dey to chop and wine go dey to drink; betta meat and sweet wine go dey too.


Pipol wey nor know anytin, dey die bikos dem rijet wisdom and distroshon go follow doz wey bi fool, bikos dem feel sey wisdom nor koncern dem.


Na wons dem tif and empty evritin for di town kon turn am to where dem dey trow dirty put. Dia heart melt and dia leg kon dey shake. Honga won kill pipol and pipol face don dey shange kolour!


Wen una dey prosper and enjoy, God tok to una, but una nor gri listin. Na so una dey bihave since and una nor gri obey God.


But di time dey kom wen I go send pipol go pour Moab pipol, just as dem dey pour wine. Di wine pot for Moab go empty and dem go break di pot to pieces.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka