Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 47:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 “Look! Wota dey boil for nort and e go rush kom like river wey dey flow. Dem go kover di land plus evribody and evritin wey dey der. Pipol go dey shaut for help and evribody for di eart go kry well-well.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 47:2
32 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Egypt bi like fine melu, but sojas from nort go kom attack am like wiked fly wey dey bite pesin.


Awa enemies don already dey Dan town; wi dey hear dia horse nois and as di whole town dey shake. Awa enemies dey kom distroy awa land. Dem dey kom distroy awa town and evribody wey dey inside.”


So God tell mi, “Dis mean sey, na from nort I go start to distroy kom and I go distroy evribody wey dey di land.


Den di angel kon tell mi, “Di wota wey yu si, wey di ashawo sidan on-top, na many pipol, tribe, kountry and language.


Den one from di seven angel wey whole di seven basin tell mi, “Kom make I go show yu how God go kondemn and ponish dat ashawo wey sidan on-top plenty wota.


Yu wey get money, make yu listin! Cry make dem hear yor vois, bikos of di bad tins wey go happen to yu.


But if di pesin tell yu sey, “Dem sakrifice dis food give juju,” make yu nor chop am bikos of di pesin wey tell yu and en konscience.


Bikos God word sey, “Di eart and evritin wey dey inside, na di Oga God own.”


But E go use heavy rain take distroy en enemies finish kon porshu dem enter darkness.


Anybody wey ask am kweshon about di High Priest, e go kill-am.


Moab don skata! Make una kry well-well, bikos dem don disgrace Moab. Di town don skata and all di nashon wey dey round am, dey laf am. Mi, wey bi God, don tok.”


Wen King Nebukadnezzar kom attack Egypt, God tell mi sey,


From east go rish west, evribody go fear en and en great pawa. E go kom like river wey dey rush well-well and like strong breeze wey dey blow.


Na justice dem go take measure di foundashon. And na trut dem go take build am.” Big-big stones go fall kon kill all di pipol wey dey lie well-well and wota go distroy all di place where dem tink sey dem dey save.


Dis message na about di Vishon Valley: Wetin dey happen? Wetin make evribody dey klimb go on-top roof?


True-true, pipol dey hear as Moab pipol dey kry for evriwhere and dia kry dey rish Eglaim and Beer-Elim town.


Filistia towns! Make una shaut and kry for help. Make una fear, bikos betta smoke dey kom meet una from nort and dem bi strong sojas wey nor dey fear.


Make di sea and evritin wey dey inside, shaut praiz God! Make di eart and evry living tin join dem too.


Make di heavens and di eart dey happy! Make di sea and evritin wey dey inside, shaut praiz God!


If to sey I dey hongry, I nor go tell una, bikos na mi get di world and evritin wey dey inside.


Na God get di eart and evritin wey dey inside. Di world and evribody wey dey stay inside, na en own too.


“God sey, ‘Si, sojas dey kom from one land for nort; one nashon wey dey far and dem dey ready to kom fight.


Oda nashons don hear of una shame and evribody don hear una kry. One soja fall press anoda one and unasef don fall rish groun.


Dem disgrace Egypt pipol and na doz from nort win dem. Mi, wey bi God, don tok.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka