Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 46:27 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

27 “So make my pipol, Israel nor fear! Make una heart nor shake. I go save una from dat land wey far wey una for bi prisonas. Una go kom back to una land kon stay for peace. Una go dey save and nobody go make una fear again.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 46:27
24 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Make una nor fear, bikos I dey with una! I go bring una pipol from east and west kom house back.


Naw, God wey kreate una sey, “Make una nor fear, I go save una. I don koll una by una name and una bi my pipol!


I go take Israel pipol go back to dia land. Dem go chop from Mount Karmel and Bashan. Dem go chop beleful for Efraim hill and Gilead land.


Yes! I sey, una go find mi and I go bring una kom back to una land. I go gada una from evry kountry and place wey I skata una go and I go bring una kom back to di land wey I from send una go Babilon. Mi, wey bi God, don tok.’


I go bring my pipol kom back to dia land. Dem go ribuild dia towns wey skata kon stay der again; dem go plant vine kon drink di wine; dem go plant food for dia farm kon chop wetin dem plant.


As e dey rule, Judah pipol go dey save, while Jerusalem pipol go stay for peace. For dat time, dem go koll Jerusalem town, ‘God Don Save Us.’


Wen e bikom king, Judah pipol go dey save and Israel pipol go stay for peace. Dem go koll am, ‘Na God bi awa raitiousness.’ ”


Dis na wetin God tok, “Na mi kreate and form una for una mama belle kon help una, so make una nor fear, bikos una bi my savant; di pipol wey I choose and love.


“I go gada all my pipol from di kountry where I skata dem put, bikos I bin dey vex and I go bring dem back to dis land, so dat dem go dey save.


God wey get pawa sey, “But naw, I go sorry for Jakob shidren wey bi Israel pipol kon make dem prosper again. Yes! I go guide my holy name.


From evry tribe, kountries or towns wey una dey, I go bring una kom back to una house.


Wen God don free Israel pipol from dia pain, sofa and di hard work wey dem force dem to do,


God sey, “Make una listin, Israel pipol wey bi my savant and Jakob shidren-shidren wey I choose.”


Make una nor fear or luz hope, bikos of wetin una hear. Dem go dey tok difren tins evry year about fight for di land and dem go sey one king dey fight anoda one.


God tell Jerusalem, “Sodom and Samaria town, I go make una grow and prosper again.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka