Den, Judah pipol wey remain, wey don make up dia mind sey dem won go Egypt, I go make sure sey, dem distroy dem finish. Both big and small go die for Egypt; weda na for war or honga. Pipol go si dem dey fear and dem go trit dem anyhow kon use dia name as curse.
Bikos I don make up my mind sey I nor go sorry for dis town, so I go distroy am. I go gi-am to Babilon king and e go burn am rish groun. Mi, wey bi God, don tok.”
sey make I tell Ebed Melek wey kom from Ethiopia sey, “Israel God wey dey mighty sey, ‘Just as I promise, I go distroy dis town and nor-tin go remain.’ And yu go si am wen e dey happen.
Judah pipol wey kom stay Egypt, nobody among dem go eskape or survive. Nobody among dem go-go back to Judah, wey dem like to go stay again. Nobody go-go back, escept some slave.’ ”
Some of una go die bikos of honga; sickness go kill some; swod go kill anoda set for outside di town and di remain wons, I go skata dem for air kon porshu dem with my swod.
Mi wey bi God wey get pawa dey look as Israel kingdom dey sin, so I go distroy dem komot for dis eart. But I nor go distroy Jakob shidren-shidren finish.
So, make yu listin to wetin mi, Israel God wey get pawa go do: ‘I go make dis pipol chop bitter food kon make dem drink di judgement wota wey get poizin.