Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 43:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Nebukadnezzar go kom win Egypt. Di pipol wey I don sey diziz go kill, na diziz go kill dem; doz wey dem go karry go as prisonas, dem go karry dem go and doz wey dem go kill for war, go die for war.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 43:11
15 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

I go ponish all di pipol wey dey Egypt, just as I take war, honga and diziz take ponish Jerusalem pipol.


If dem ask yu, ‘Where wi won go?’ Tell dem sey, ‘God sey: “ ‘ “Pipol wey dem don sey, na diziz go kill, na diziz go really kill dem. Doz wey dem sey go die for war, go really die for war. Doz wey dem sey na honga go kill, na honga go kill dem and doz wey dem sey dem go katch go as slave, dem go katch dem go.” ’


Den I tell di sheep sey, “I nor go bi una shepad again. So doz wey won die, make dem die and doz wey dem go distroy, make dem distroy dem. Doz wey remain, go distroy each oda.”


Dis na di oda pipol wey drink from di cup: King Fero for Egypt; doz wey dey serve am; en ofisas, en pipol;


Some of una go die bikos of honga; sickness go kill some; swod go kill anoda set for outside di town and di remain wons, I go skata dem for air kon porshu dem with my swod.


Dis na wetin go happen to wiked pipol! Dis na wetin God go do dem.”


Anybody wey dem suppose to katch, dem go katch am. Anybody wey swod go kill, dem go kill-am with swod. So, God pipol must bear well-well and get faith.


Oga wey bi Israel God tell mi, “Make yu take dis wine cup wey my vexnashon full and make all di nashons wey I send yu go meet, drink from am.


So make una remember sey; una go die for war and honga and diziz go kill una for di land wey una dey run go stay.”


human being or animal nor go waka pass der again and for forty years, nor-tin go stay for der.


Den, Judah pipol wey remain, wey don make up dia mind sey dem won go Egypt, I go make sure sey, dem distroy dem finish. Both big and small go die for Egypt; weda na for war or honga. Pipol go si dem dey fear and dem go trit dem anyhow kon use dia name as curse.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka